Lekki Toll Gate Lagos Nigeria [EndSARS protest]: Mr Macaroni, odas wey 'observe' Lekki tollgate protest go pay bail of N100,000 13 February 2021


News Update 

Some protesters don give up with dia demonstration against di handover of Lekki toll gate to di owners, Lekki Concession Company [LCC].

Upon di heavy presence of security personnel for Lekki Tollgate on Saturday, February 13, di protesters still continue dia demonstration against di reopening of Lekki Tollgate.

Dis protesters dey vex for di decision to resume operations for di tollgate while di Lagos State Judicial Panel neva conclude dia sitting to torching wetin happun for di tool gate on October 20, 2020 during di Endsars protest.

Police arrest some pesin wey dem suspect to be protesters including popular comedian Mr Macaroni.

Fotos of wetin happun today for di popular Lekki Tol gate don flood di internet. Here na fotos wey BBC Pidgin reporter wey dey di scene carry come.





Post a Comment

My Instagram

Copyright © OKBEST SYSTEMS. Designed by OddThemes